![]() |
5 Habits Keeping You Broke |
But good news be say—if you fit identify am,you fit break free. Here are 5 money habits wey dey hold many Nigerians back, and exactly how you fit stop them in 2025๐
๐ฃ 1. Spending Before Budgeting
As money enter like this ,you don already dey plan soft life—shawarma, data, new wig or polo๐ But by the time you try calculate balance ,nothing dey again.
Fix it:
Before you touch any alert or casg, sit down and write out your basic needs.Use apps like Money Manager or just jotter. Even 500naira well planned is better than 5k wasted
๐ 2. Living for Social Media
Instagram, Tiktok and Whatsapp dey push people to buy clothes, gadgets ,and lifestyle wey dem never reach.
You dey try keep up with someone wey dey earn x5 your income. How?
Fix it:
Unfollow "pressure accounts," mute stories if you must. Your real flex na when your account balance dey smile, not your IG comments.
๐ธ 3. Ignoring the 'Small' Expenses
300 naira data today. 500 naira shawarma tomorrow. By Friday you don spend 7k naira and you no even know how e vanish.
Fix it:
Track Your spending for just 7 days. You go shock. Use a notebook or app—No need to form. Awareness alone go change your mindset.
๐ณ 4. Saving What's Left Instead of Saving First
You dey wait make money "plenty" before you go save.
But money no dey ever plenty when bills pass your balance.
Fix it:
Save first. Even if na 500 naira every week. Put am for separate account wey no get ATM. Make am hard to touch.
๐ 5. Relying on Only One Source of Income
Salary allowance alone no dey do again. Prices dey for up, but income no dey follow climb.
Fix it:
Start small—learn a digital skill, freelance writing, blogging (just like me ๐) or offer simple services online. The extra cash go save you during hard times.
You no need to make 7 figures before you gain control over your money—
Na the small small smart habits go carry you far. 2025 fit be your financial glow-up year, but e go start from mindset.
๐ฌ Call to Action(CTA)
Which of these habits don hold you back before?
๐Drop am in the comments or just type "I dey break free in 2025" to claim your financial freedom.
And abeg , share this post with someone wey you know dey always broke before month end. Make we all rise together ๐.
No comments:
Post a Comment
"We'd love to hear your thoughts! Please keep it respectful."